For Mum…Our Song

Sweet Mother
by Prince Nico Mbarga
[click link to hear the song]

Sweet mother I no go forget you
For de suffer wey you suffer for me yeah [2x]

When i dey cry my mother go carry me
She go say my pikin wetin you dey cry yeah yeah
Stop stop! stop stop!! stop stop!!!
Make you no cry again oo

When i wan sleep my mother go pet me
She go lie me well-well for bed
She go cover me cloth say make you sleep
Sleep sleep my pikin oooo

When i dey hungry my mother go run up and down
She dey find me somthing wey i go chop
Sweet mother eeeeee..sweet mother oooo..eee

When i dey sick my mother go cry cry cry
She go say instead wey i go die make she die
She go beg God, God help me, God help me, my pikin oo

If i no sleep, my mother no go sleep
If i no chop, my mother no go chop
She no dey tire ooo
Sweet mother i no go forget dey suffer wey you suffer for me yeah yeah
Sweet mother eeeeeeeeeeee
Sweet mother oooo….eeeee

interlude…instrumental…

You fit get another wife
you fit get another husband
but you fit get another mother? No!

interlude…instrumental…

Sweet mother aaaaaaaaaaaaa
Sweet mother eeee..ooooooo
Sweet mother aaaaaaaaaaaaa
Sweet mother eeee..ooooooo

20140511-165641.jpg